Family and friends on social media dey mourn di death of Salome Adaidu wey her boyfriend allegedly behead for Nasarawa State, north-central Nigeria.
Dem allegedly gbab Timileyin Ajayi wey be gospel singer wit Adaidu head on Sunday 12 January near one church for Orozo.
One video wey go viral on social media show as pipo surround Ajayi wen dem gbab am and begin ask am question about di human head and di lady.
She tok say Adaidu na im girlfriend and add say dem don dey date for about one year.
Police for Nasarawa confam di incident to BBC News Pidgin and add say dem find di remains of di victim wey don dey cut into pieces for im house.
Nasarawa.
Di police say di bike man notice say blood dey drop from di passenger bag, e raise alarm and pipo begin gada to beat Timileyin.
“Di mob beat di suspect and pipo call di police to rescue di suspect. We rescue di suspect and discover human head. We carry am go hospital for medical treatment,” Nansel tok.
Nansel say dem follow up wit di mata to go search Timileyin house wia dem find di mutilated body of di 24-year-old Salome Enejo Adaidu for inside nylon bag.
“We get search warrant to search im residence wia we find di remains of di victim, Salome Enejo Adaidu, corps member, cut into pieces and pack into nylon,” e tok.
Police say dem no dey aware of di relationship wey dey between Timileyin and Adaidu.